Black Axe: Suspected members of Black Axe crime gang chop arrest for Switzerland | #cybercrime | #infosec

[ad_1]

Black Axe

Read am in 3 mins

Suspected members of d Nigerian-linked Black Axe crime gang don chop arrest for Switzerland sake of accuse say dem dey involved for romance scams and cyberfraud, Reuters report.

Black Axe bin grow out of student fraternity for di late 1970s called di Neo Black Movement ⁠of Africa, and e don evolve since into structured, violent criminal organisation wey dey always deal in financial cybercrime.

“Di suspects chop accuse of numerous crimes. Dis include romance scams and oda cyberfraud offences wey cause millions of Swiss francs in damages, as well as ‌money ⁠laundering,” Europol tok inside one statement. Europol headquarters dey for The Hague.

Di pan-European police body say 10 pipo – most of dem get Nigerian origin – chop arrest for one operation wey also involve German police.

Di Swiss operation against ⁠di Black Axe crime gang follow one similar operation Spanish police carry out for January, while global police body Interpol don also target dem for 2023.

International police organisations dey clampdown on cybercrimes and many arrests don happun.

For February, di global police agency Interpol say law enforcement bodies from 16 African kontris bin arrest 651 suspects and recover more dan $4.3 million, for inside one major crackdown against transnational online scams.

For one statement dem release on Wednesday, 19 February, Interpol tok say di operation wey dem name Red Card 2.0, run for eight weeks – e start from 8 December 2025 to 30 January dis year.

Interpol say Operation Red Card 2.0 bin target di infrastructure and actors behind high-yield investment scams, mobile money fraud and fraudulent mobile loan applications.

During di eight-week operation, investigations expose scams wey dey linked to ova USD 45 million in financial losses and dem identify 1,247 victims, wey mostly come from African continent and from oda regions of di world.

Also, authorities also seize 2,341 devices and take down 1,442 malicious IPs, domains and servers, plus oda related infrastructure, di statement add.

“Dis organised cybercriminal syndicates dey cause serious financial and psychological harm on individuals, businesses plus communities wit dia fake promises,” Neal Jetton, Interpol Director of di Cybercrime Directorate tok.

Some of di kontris wey follow for di operation include Angola, Cameroon, Côte d’Ivoire, Kenya, Nigeria, and Zimbabwe.

[ad_2]

Click Here For The Original Source.

——————————————————–

..........

.

.

National Cyber Security

FREE
VIEW